
Wia dis foto come from, Getty Images
Nigerian superstar musician Ayra Starr don become di first woman wey go carry di award for best African music for di Mobo Awards in di last 16 years.
Di singer also gbab di award for best music act, as di first woman ever to do am, for di ceremony wey happen for Newcastle.
As she collect di award, Ayra Starr acknowledge di fact say na her first Mobo win.
She tok say, “Dis dey nice. Dis na my first Mobo and na di first time wey I dey win Mobo awards. I dey shake now sef, I dey nervous.
“Thank…