Asake concert in Kenya: Karen Lojore die for crush wey hapun for Nigerian singer concert – BBC

A Nigerian singer wearing sunglasses, a cap, and a large chain necklace performs on stage with colorful lights at the Asake concert Kenya. The BBC News Pidgin logo is visible in the corner.

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 6 mins

Nigerian Afrobeats star Asake don speak afta di death of 20-year-old Karen Lojore, wey die afta one crush wey hapun for di concert e headline for Nairobi, Kenya.

For one statement on Monday, Asake say, “I dey devastated by di tragic incident wey happun for di festival on 20 December.

“My heart go out to di family, friends and loved ones of Karen Lojore,” e tok, as e promise to support efforts to “understand wetin really hapun”.

E say music na…